Palais de Tokyo: Why dis Paris museum allow plenty naked visitors at once

Na cartoon drawing of pipo wey no wear anything aka "Nudist waka inside Palais de Tokyo"

Wia dis foto come from, Association des Naturistes de Paris

Wetin we call dis foto, Palais de Tokyo na di first gallery for paristo open its doors to pipo wey believe nature' way of life to waka naked
Read am in 1 mins

One Paris museum don for di first time open dia gallery to welcome naked visitors.

Paris' Palais de Tokyo contemporary art museum on Saturday May 5, 2018, open dia door for visitors wey appear naked to waka enter, do free tour during special visiting hours.

Dis na di first time wey any gallery for di French capital - pipo for di capital believe say nature' na way of life - go allow pipo waka naked korokro for event.

Na like 160 pipo wey no wear cloth and shoe, show and organizers sell all dia tickets finish for di event

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Why dis Paris museum allow plenti naked visitors at once?

Tori be say, dis naked visitors first show for di museum before di main opening hours.

"Di pipo wey believe nature' as way of life, prefer to dey naked. Culture na part of our daily life, and dis na special opportunity," Julien Claude-Penegry, wey be communications director of Paris Naturists Association, tell Reuters news agency.

Wetin we call dis Video, Di artist wey dey dance naked

Claude-Penegry say, "Today, di way pipo dey tink don dey change. pipo wey believe nature... dey push pass dia boundary, taboos or tinking wey dey block dem."