Meet di Nigerian Policemen wey neva chop bribe before

'Police na you friend' na di common saying wey you fit see for Nigeria Police station, but e go hard small to see pesin for di kontri wey trust police.
To dey collect bribe and treat pipo anyhow na wetin most pipo don experience wit Nigeria Police Force.
For 2017, di Nigerian Police carry last position as di 'worst police force' for di world, for ranking wey International Police Association and di Institute for Economics and Peace do.
But e be like two policemen wan change di way pipo take dey look police for Nigeria.
Kenneth Nwosu and Adekunle Rufus Adedeji, recently collect award as di "most incorruptible policemen for Nigeria" by di Constitutional Rights Awareness and Liberty Initiative (CRALI), wey be human rights group, in conjunction with di US Consulate for Nigeria.

Wia dis foto come from, Ken and Adekunle
Adekunle Rufus Adedeji wey be superintendent wey dey in charge of di Criminal Investigative Bureau for Ekiti State neva collect bribe before. Na di same for Kenneth Nwosu wey be di new Divisional Police Officer of di Kwani divisional headquarters of di Sokoto State police command.
Adekunle Rufus Adedeji tell BBC Yoruba for di ceremony say im dey feel one kain wen im see Nigerians dey talk bad about di police and say no be dem dey responsible for poor performance:
"Yes police get bad eggs, but officer behaviour mostly depend on how dem bring am up for im house. Na wetin dey happen for society dey show so for police."
End of Di one wey oda users dey read well well
Im say na goment dem suppose blame for wetin police don become.
"I wan ask goment to make tins available wey go make police enjoy di work. Wen police officer no dey sure say wetin e want go come, im go begin chook eye for oda ways to feed imself and family."
Im talk say sha dat one no be reason for officers to ask for bribes or to abuse people rights.
Im wife, Omolola Adedeji, say her husband don make am clear to her say make she no expect "tins wey im no work for, for house."
"I no dey ask for wetin im no get".










