Pipo no understand say Nigerians dey suffer - APC leader Bola Tinubu

Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Getty Images

National leader of Nigeria's ruling All Progressives Congress (APC), Bola Tinubu don tok say di problem di kontri dey face na say pipo no understand say Nigerians dey suffer.

Mr Tinubu tok am wen im dey launch book wey dem write to honour Emir of Gwandu, Alhaji Muhammadu Illiasu Bashar for Birnin-Kebbi.

Di chieftain say na dis kain tin dey divide di kontri and dey make pipo quarrel.

Wetin we call dis Video, Nigerians talk dia own on top Obasanjo coalition letter

E say pipo wey wan divide di kontri suppose understand say pipo go still continue to live togeda even afta goment end.

Wetin we call dis Video, 2019 election: 'Our mumu don do' - Sowore

Mr Tinubu say pipo suppose to dey preach peace, tribal war no suppose dey and pipo suppose to dey share.