15 pipo die and 83 odas wound as Nigeria army jam Boko Haram for Maiduguri

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria army say 15 pipo don die for di fight wey dem fight Boko Haram militants outside Maiduguri, di capital of Borno state wey dey north east of di kontri.
Police bin confam give BBC say shooting dey happen for di area and pipo wey dey live for Jidari Polo, wey no too far from di capital, say dem hear as bomb dey blow and bullet dey fly upandan and army say e reach 83 pipo wey wound for di fight.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Borno don suffer many Boko Haram attack as di militant dey try start wetin dem call Islamic caliphate for di region.
E don pass 30,000 pipo wey don die since di gbege start for 2009.

Wia dis foto come from, AFP/GETTY
President Muhammadu Buhari enta office for 2015 and e tok say im main agenda na to stop Boko Haram but e be like say water pass Gari.

Wia dis foto come from, AFP/GETTY IMAGES
For di statement wey dem release, di army tok say soldiers wey dey dia 'Operation Dole' stop di militants for Jidari Polo as dem dey try enta Maiduguri.
Dem say di air force, police and oda security pipo follow join di fight to chase di militants comot.

Wia dis foto come from, AFP/GETTY IMAGES
Pipo wey dey di area bin report say plenti army pipo land for di place even as pipo dey run away.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di army don beg say make pipo wey run comot go back as dem don secure di area.












