You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cambridge Analytica do wuru-wuru for Nigeria 2007 elections
One paper wey BBC see from di owner of SCL Elections don show say Cambridge Analytica bin dey do yanga say dem put hand inside Nigeria 2007 elections.
Many pipo wey put eye for dat year elections bin talk say, di voting mata no pure.
Dat year, na late Umaru Musa Yar'Adua bin contest and win President Muhammadu Buhari.
Cambridge Analytica get plenty palava as many kontris and pipo dey vex say dem use data of millions of Facebook users.
Di paper wey BBC see show say dis mata dey before 2014 because anoda tori dey wey UK 'The Guardian' write say Cambridge Analytica get hand for di 2015 general elections wey Goodluck Jonathan win.
Inside di paper dem claim say dem arrange campaign for Nigeria make di opposition leg no too strong.
As e be so, many pipo for Nigeria dey vex for all di tori wey dey comot say di company fit get hand wey spoil as elections for happun for di kontri.