You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How ruling party win Angola election
Di Angolan electoral commission don say results of di parliamentary election don show say di ruling MPLA (People's Movement for the Liberation of Angola) party don win.
Di electoral bodi talk say di MPLA don win nearly 2/3rd of di vote wey dem don count.
Di election commission add say main opposition party wey bi UNITA, get like twenty-five percent of di vote.
As e bi so, di former defence minister, Joao Lourenco, wey be di person wey President Jose Eduardo dos Santos choose, fit be di next president.
President dos Santos don dey rule Angola since 1979. E come choose im defence minister as di person wey go enter di office after im don comot. Lourenco contest do election against Isaias Samakuva wey be di leader of opposition party, UNITA wey don dey oppose MPLA since di Angola civil war end for 2002.