Nigeria: 3 people don die after Jeep jam Danfo for Lekki toll gate

Wia dis foto come from, Twitter/rrslagos767
- Author, Karina Igonikon
- Role, Reporter, BBC News Pidgin
- Read am in 1 mins
E reach three people wey don die for Lagos, Nigeria dis Sunday 11 March after one Jeep jam Danfo for Lekki toll gate.
Officials wey dey work for di toll gate say di Jeep dey follow one-way come jam di danfo wey dey come from Lekki side.
Plenty people wound for di accident and Lagos state emergency agency carry some people go Marina General Hospital and odas go Gbagada.
One person wey dey dia when di accident happen video am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
BBC tori person Karina Igonikan wey dey di Marina hospital say na eight people dem carry come and one of dem don die. Tori be say two don die for Gbagada hospital.

Tony, wey be one of di passenger inside di Danfo wey dey collect treatment for hospital talk say na from Ikate im follow enter di bus and e shock as di di thing happen.
Im say dem dey give dem medicine wey go make dem sleep as treatment dey continue.
Di man wey dey drive di Jeep wey jam di Danfo bus sef dey take treatment for di hospital.
End of Di one wey oda users dey read well well












