Bicycle suicide bomber don kill three pipo for Muna Dalti

One man wey dey ride bicycle don do suicide bomb attack kill three people outside Maiduguri, Borno state wey dey northeast Nigeria.

Di attack happen for Muna Dalti town for night as people dey gather to hang out.

Vigilante people wey dey follow help do security against Boko Haram say e reach eighteen people wey wound for di explosion.

Musa Ari, wey be one of di vigilantes, tell tori people AFP say im sure say na di work of Boko Haram.

Another vigilante leader, Ibrahim Liman, say di suicide bomber blow di bomb as im dey ride im bicycle pass people wey dey hang out.

No be today wey attacks don happen for di Muna area wey plenty Boko Haram refugees full.

Dem don attack di camp wey dey dia, military and civilian checkpoints, and bus station sef don follow suffer attack.