Rann attack: UN don suspend work for di town after di Boko Haram attack

United Nations for Nigeria don suspend di humanitarian work wey dem dey do for Rann, Borno, wey dey northeast of di country.

Boko Haram bin attack di town and kill three aid workers. One get serious wound and three still dey miss.

UN talk-talk person, Samantha Newport, talk for Abuja say dem go pause operation for di area for one week.

Newport talk say dem don carry 52 aid workers comot, plus including di three wey die.

E reach like 55,000 people wey dey IDP camp for Rann wey need di help wey di UN dey help provide food and oda things.

Tori be say no be di aid workers di militants bin target but na military dem bin plan to attack. Na eight Nigerian soldiers dem kill for di attack.

Newport say dem go check di damage wey di attack cause and security mata, but she no think say e go affect di people wey dey Rann.

Di people wey die for di attack na people wey dey work for di International Organization for Migration and di UN children's fund Unicef.

Doctors Without Borders (MSF) don already announce say dem don suspend dia work for dia and go comot dia 22 workers.