Yobe State: Army don rescue 48 missing schoolgirls

Wia dis foto come from, BERTRAND GUAY/AFP/GETTY IMAGES
Di Yobe State government for Nigeria say army don rescue some female students of di Government Girls Science Technical College, Dapchi, wey Boko Haram bin kidnap on Monday night.
Local media dey report say na 48 out of 94 pupils wey bin dey miss don show face.
For statement wey Abdullahi Bego, di talk-talk person for di governor sign na im dem say dem rescue di girls near Gaidam - wey be border town with Borno State, north east Nigeria.
Then di Yobe State Commissioner for Education, Mohammed Lamin, add say di state government don dey organise how to search for di remaining 46 girls.
All dis latest tori dey come after di Yobe police commissioner Abdumaliki Sunmonu bin say police could no fit know if all di missing girls na case of kidnapping.
But di latest statement from di Yobe government add say di girls wey dem rescue don dey with di Nigerian Army, and authorities go give more tori about how many girls dem rescue, and how dia bodi be.
BBC tori person Chris Ewokor say e never clear if dem find all di missing girls, and di school get nearly 1000 students.
Nigeria President Muhammadu Buhari bin don give military, police and other security forces order make dem quick-quick take control of di school.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di president give dis order on top tori say '94' schoolgirls don miss after armed militants, wey fit be Boko Haram, go attack di girls' school for Monday.
As part of di order from di Presidential Villa, two senior ministers - Defence and Foreign Affairs - go visit di school for Thursday morning wey be 22 February.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Na di Minister of Information and Culture, Alhaji Lai Mohammed, tell State House tori people wetin President Buhari talk.
At di end of di weekly Federal Executive Council meeting for Presidential Villa, Abuja Mohammed talk say, ''Dan-Ali (Defence) go lead special government team wey go include Geoffrey Onyeama (Foreign) go Dapchi, see with dia own eyes wetin dey ground for Thursday morning''.
''As soon as we get any information, we go tell una''.
Di Yobe state government don talk say 48 of di 94 students of di school wey miss after di Monday attack don return.
E be like some of di students run comot after di attack and dem still never show for town.











