You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Black Panther don scatter box office record
Black Panther don make more than two times di amount of money for e first weekend.
Instead of di $120m experts dem expect say di film go collect for US and Canada cinema dem, di film get bank alert of $242m.
Di movie don become di second-highest film for history wey make money pass for e first four days, after e collect $288m for US and Canada cinema dem.
Black Panther don also become di film wey go make money pass for e first Monday as e chop $40.2m, use am clean mouth.
Dis records happy di film director Ryan Coogler sotay im use letter say thank you to people wey go watch di film.
"E dey hard me to show una how happy l dey right now," Coogle talk.
"Thank you for di ogbonge present una don give my team wey make di film."
Meanwhile, Michelle Obama don congratulate di team wey make di film.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di first lady talk for social media say, "I love dis movie".
"Because of una, young people go now see powerful-men wey look like dem for cinema" she talk.