Black Panther don scatter box office record

Chadwick Boseman and Lupita Nyong'o

Wia dis foto come from, Getty/PA

Wetin we call dis foto, Chadwick Boseman and Lupita Nyong'o na two actors wey show for di movie
Read am in 1 mins

Black Panther don make more than two times di amount of money for e first weekend.

Instead of di $120m experts dem expect say di film go collect for US and Canada cinema dem, di film get bank alert of $242m.

Di movie don become di second-highest film for history wey make money pass for e first four days, after e collect $288m for US and Canada cinema dem.

Black Panther don also become di film wey go make money pass for e first Monday as e chop $40.2m, use am clean mouth.

Film Director Ryan Coogler with actor Lupita Nyong'o for di South Korea premiere

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Film Director Ryan Coogler with actor Lupita Nyong'o for di South Korea premiere

Dis records happy di film director Ryan Coogler sotay im use letter say thank you to people wey go watch di film.

"E dey hard me to show una how happy l dey right now," Coogle talk.

"Thank you for di ogbonge present una don give my team wey make di film."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Meanwhile, Michelle Obama don congratulate di team wey make di film.

Di first lady talk for social media say, "I love dis movie".

"Because of una, young people go now see powerful-men wey look like dem for cinema" she talk.