Not Too Young To Run Bill fit happen for Nigeria?

Wia dis foto come from, YIAGA
Di people wey dey do 'Not Too Young To Run' campaign for Nigeria don ask say make di state House of Assembly do quick-quick to pass bill on di matter.
Dem talk dis one for press statement for Abuja, Nigeria capital, as dem dey talk say di country need restructure di political system as e no dey favour young people.
As e be so na only 16 states House of Assemblies out of 36 states for Nigeria don sign di bill wey dey allow make dem reduce di age for people wey dey find big-big position for government.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
According to Section 9 (2) of the 1999 Constitution of the Federal Republic of Nigeria (as dem amend am) for dem to amend constitution den at least 24 state Houses of Assembly for don gree on top a new bill.
Di Not Too Young To Run still need like eight states to sign am.
Di group bin ask say make di other states do good to votes 'yes' for dia side; as dem see say if di bill finally show, things go better for youth and di next generation.
Dem talk say di 2019 elections go be better chance for young people to show demsef say no be to only vote dem sabi but dem fit also run as candidates.
Di Not Too Young to Run bill na bill wey dey try to reduce di age of people wey dey find political position, from president to House of Assembly.
End of Di one wey oda users dey read well well












