Cameroon Constitutional Council go work after 22 years

Paul Biya

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO

Wetin we call dis foto, President Biya don also sign decree for Cameroon elections wey go hold dis year
Read am in 1 mins

Presidential decree don organise, show how Constitutional Council go work.

President Paul Biya sign decree on Wednesday for reorganise and make functional dis organ for regulate institutions dem.

Since government create Constitutional Council, na dis year de organ go function after 22 years and for dis taim, na Supreme Court be di act.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dr Hilaire Kamga, executive Secretary for NGO 'New Human Rights' tell BBC News Pidgin say though e di kam late, e still dey important for get Constitutional Council and say e kam for beta taim.

Constitutional Council na de only institution weh fit regulate institutions dem for normal taim and also if president no dey, e add.

But Kamga say de problem na de pipo weh president appoint, some wan dem weh dia character no clear.

"Since weh na de Constitutional Council go give result for senatorial and presidential election, politically worry deh", e explain.

Na list dis for members:

  • President: M. Atangana Clément weh na former magistrate and president for admin chamber for supreme court
  • Members: M. Bonde Emmanuel ;
  • M. Atangana Clément ;
  • M. Bipoum Woum Joseph Marie ;
  • Mme Arrey Florence Rita ;
  • M. Essombe Emile ;
  • M. Paul Nchoji Nkwi ;
  • M. Baskouda Jean-Baptiste ;
  • M. Bah Oumarou Sanda ;
  • M. Lekene Donfack Charles Etienne ;
  • M. Fouman Akame Jean ;
  • M. Ahmadou Tidjani.