Dr Alex Ekwueme: Nigeria don bury former vice president

Ekwueme burial

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Na state burial Nigeria do for di former vice president

Nigeria don bury second republic vice president, Dr Alex Ekwueme for Oko, Anambra State, southeast of di country.

Na state burial di country federal government do, to take send home di 85-year-old elder statesman wey die for November 2017.

Some of those wey dey present to witness di final moments na Vice President Yemi Osinbajo and former President Goodluck Jonathan and im wife, Patience.

To honour im contribution to nation building, President Muhammadu Buhari don change di name of Federal University for Ebonyi State to Alex Ekwueme University.

More from Ekwueme burial.

Wia dis foto come from, other

For 1979, Ekwueme become Nigeria first vice president, as im serve as deputy to Shehu Shagari, until 1983 wen dem use coup comot dem.

Di university wey dem rename after am dey for Ndufu Alike Ikwo for Ebonyi State.