'Life go dey difficult for deported Cameroon separatist' - Lawyer

Wia dis foto come from, Getty Images
Abdul Oroh, di lawyer for di Cameroonian separatist oga, Sisiku Ayuk Tabe, and 12 others wey Nigeria authorities arrest and deport dis month dey worry for dia condition for jail.
Cameroon government talk-talk person, Issa Tchiroma Bakary, bin call dem terrorist and "dem dey di hand of di Cameroonian justice system for few hours … and dem go answer for dia crimes for Cameroon court."
Mr Oroh tell BBC Pidgin tori person Karina Igonikon say dis kain talk mean say dem no go get fair trial as, "people wey dem neva try for court, dem don already conclude say dem be terrorist.
"Dem don already try dem now, dem don imprison dem, e don condemn dem and for Cameroon if dem say person be terrorist na death be dat."

Wia dis foto come from, @GovAmba -Twitter
Mr. Oroh say e neva talk to dem since dem deport dem comot Nigeria. E say some of dem get health palava as two of dem get high blood pressure, one get kidney problem while one woman get belle.
Di lawyer bin carry di mata go Nigeria national assembly wey later tell government make dem no deport dem.
Di mata enter court sef and Federal High Court order say make government no deport dem.
But government still send dem go back to Cameroon, even as e dey against section 33 of di Geneva convention.
End of Di one wey oda users dey read well well
So now, Mr Oroh dey tell di international community to ask Nigeria why dem disobey court order and international conventions come deport dem go Cameroon.

Wia dis foto come from, Sisiku Ayuk/Facebook
Some of dis people don dey live and work for Nigeria for a very long time as university lecturers and some na lawyer wey dey practice for Nigeria. Mr Oroh talk say some of dem follow get dual citizenship as dem be part Cameroon, part Nigeria and some get US citizenship.
Im also say some of dem don register as refugees with United Nations.
Di lawyer want make Cameroon government allow doctors to see dem, plus including Red Cross and refugee people dem.













