You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria: Why dem close down Abuja airport
Read am in 1 mins
Di Federal Airports Authority of Nigeria FAAN don reopen di runway for di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja, after dem bin close am for about one hour on Thursday.
Dem bin close di runway after one private plane wey wan land for di airport get wahala come lose im tyre on top.
Hadi Sirika, wey bi Nigeria Minister for Aviation tell tori people say because of dis accident, dem close di airport for 30 minutes.
But people wey bin dey di airport talk say e reach one hour wey dem close di runway.