Nigeria: Why dem close down Abuja airport

Abuja airport

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Read am in 1 mins

Di Federal Airports Authority of Nigeria FAAN don reopen di runway for di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja, after dem bin close am for about one hour on Thursday.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dem bin close di runway after one private plane wey wan land for di airport get wahala come lose im tyre on top.

Hadi Sirika, wey bi Nigeria Minister for Aviation tell tori people say because of dis accident, dem close di airport for 30 minutes.

But people wey bin dey di airport talk say e reach one hour wey dem close di runway.