You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Pope Francis surprise flight workers as im marry dem for plane
Pope Francis don make history after im marry two flight attendants for plane wey dey fly 36,000 ft for Chile airspace.
Paula Podest Ruiz, 39, and Carlos Ciuffardi Elorriga, 41, don do marry for registry already when dem ask Pope to bless dia marriage.
"You wan make l marry una?" na wetin di Pope ask dem.
Di couple talk say na 2010 earthquake wey spoil dia church for Santiago, Chile capital no make dem do white wedding.
Pope Francis talk say im ready to marry dem during im short flight from Santiago to Iquique, northern Chile.
Pope do di Catholic wedding service for di couple, wey include di oga for di airline wey act as dia witness.
One Cardinal wey waka with di Pope for im trip around Chile, use im own hand, write di paper wey di bride, groom, and witness sign.
One American journalist, Steve Dorsey with CBS News, show di paper for social media.
End of Di one wey oda users dey read well well