Universal mannequin: Beta don land for tailors dem

Man wey hold mannequin.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di universal mannequin go help people wey dey di fashion industry to do dia work quick-quick.
Read am in 2 mins

Person wey dey fashion industry no dey fit escape to use mannequin or 'doll-baby' to sample dia cloth.

If na five different sizes of clothes di fashion designer get, e mean say na e go need to buy five different doll-baby just to sample cloth. No be small money to buy dem, and space inside shop na different expenses di mata fit cause.

Some tailors dem and people wey dey sell clothes bin don find small solution to dis wahala. Instead make dem buy different mannequin, dem go use only one doll-baby, come use clip hold di cloth for back to give am fitting.

But now, one company for US don make mannequin wey fit change to any shape, size and even height.

Wetin we call dis Video, Three things from Day 3 for Lagos fashion and design week 2017

With dis mannequin wey dem dey call 'Euveka', people wey dey fashion industry no go need to get different doll-baby for different type of cloth. Fashion designers too no need to dey use clip, pin or peg to hold cloth wey dem wan sample for back.

To use dis universal mannequin, na just to type di measurements of di cloth enter di system and e go use like 10 seconds to change shape and size - e fit even change to di shape of woman wey get belle.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

One small problem wey dis universal mannequin get be say even though say di mannequin fit sample any kain cloth, na only one cloth e fit wear per time.

Dis one mean say fashion designers go still need to get pass one mannequin if dem wan get different samples for dia house.

Dis universal mannequin no dey cheap at all, as just one dey sell for around £84,000. Dat na why na only big fashion houses like Chanel and Louis Vuitton dey use am for now. Dem go begin ship di first batch of di universal mannequin by March dis year.