New Vogue oga wan use fashion talk plenty things

Wia dis foto come from, Getty Images
Di first cover for British Vogue wey new oga Edward Enninful do carry sense wey pass fashion.
For di front, dem put British-Ghanaian model Adwoa Aboah.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 1
Instead make dem talk fashion matter like bag or trending tori, dem put people like musician Zayn Malik, politician Sadiq Khan, actress Millie Bobby Brown, model Cara Delevingne join di picture of Aboah.
Dis new cover dey follow as Vogue put Enninful as editor-in-chief for April dis year.
As e be so, di picture for di cover take style resemble cover wey dem do for Italian Vogue for 1971. And e be like say people dey feel am already.
British supermodel Naomi Campbell, wey be contributing editor for di magazine, don nack her mind put for social media.
She say "dis na important day one..."
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post, 2
Who be Adwoa Aboah?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Di 25 year old be supermodel wey don work for big-big name for fashion like Calvin Klein and Marc Jacobs.
- Aboah first Vogue cover na for di Italian edition for 2015
- She dey talk about diversity for fashion industry
- She even get her own organisation wey be Gurls Talk - Dem dey use am to help women get mouth to talk different matter wey dey give dem palava like mental health
- Her hustle for Gurls Talk win her Gentleman Quarterly 2017 Woman of di Year award and she get nomination for 2017 model of the year for British fashion award
Who be Edward Enninful?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem born Enninful, for Ghana but e grow up for West London.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di 45 year old be model when im be teenager after that one na so im become fashion editor for i-D magazine wen im be 18 years old.
E don work as fashion and style director for W magazine, and im do contributing editor for Italian Vogue - na for dia im do di magazine first "Black Issue," wey only show black model dem.
Na im creativity come raise am to di job wey im dey do now as editor-in-chief for British Vogue.
Enninful also dey talk say make different people dey show for inside fashion matter and im also dey do political activity with im work.










