Di worst, but popular passwords for 2017 wey no dey safe

Wia dis foto come from, Getty Images
E don tay wen online security experts dey sama warning give people on top weak password wey dem dey use take lock dia emails and social media account.
Recently, SplashData wey be leading provider of security application and service don release list of di 100 worst passwords wey no too strong for 2017.
Di company arrange di list, after dem study five million passwords wey leak out for di year.
Di top three passwords wey dey for di list na '123456', 'password' and '12345678.'
Some others wey dey di list na 'letmein', 'football', 'iloveyou' 'welcome' 'starswars' and others.
Digital security specialist- Hyginus Horson tell BBC Pidgin tori person Igho Williams about di different kind of Passwords attacks wey hackers dey use.
E say some hackers dey use words from dictionary and dem call dis type Dictionary attack; others dey use di birthdays of people wey dem call di Birthday attack.

Wia dis foto come from, Wikkicommons
Mr Horson wey be di oga for Tapnek Global Limited, advice people make dem no dey use dia birthday or dia partner own as password.
End of Di one wey oda users dey read well well
Instead make dem use passwords wey go contain both alphabet, number and special characters like; @, #,_ and so on.
Di digital security specialist also say make people no dey use di same password for dia different social media account, because once hackers fit get di passwords of one, dem go fit enter all di accounts.
"For those wey dey quick forget dia different passwords, make dem no worry because na im make di feature of password recovery dey for di different social media platform," na wetin im add.

Wia dis foto come from, Pixabay
Meanwhile, di CEO of SplashData -Morgan Slain talk say:
"Hackers don begin use common words from pop culture and sports to break enter people account online because dem know say many people dey use those words wey dey easy for dem to remember."
See di top 20 worst Passwords for 2017
1) 123456
2) password
3) 12345678
4) qwerty
5) 12345
6) 123456789
7) letmein
8) 1234567
9) football
10) iloveyou
11) admin
12) welcome
13) monkey
14) login
15) abc123
16) starwars
17) 123123
18) dragon
19) passw0rd
20) master











