Nigeria: We never still see Burna Boy - Police

Wia dis foto come from, @BURNABOYGRAM
Di Lagos State Police Command don talk say na lie for wetin Burna Boy record label claim say di musician don go answer police invitation and dey no dey look for am again.
Spaceship Entertainment wey be di record label of Damini Ogulu alias Burna Boy been bring out statement on Tuesday say dia singer no rob Mr 2kay and e don go clear im name for police station.
But di Lagos State Police Command on Wednesday don bring out dia own statement concerning di matter.
For di paper wey di Police public relations officer-ASP Olarinde Famous-cole sign, police say:
"Na only Burna Boy papa, one Samuel Ogulu visit di Investigating Police Officer (IPO) wey dey in-charge of di case with di promise to bring Burna Boy before di police."

Wia dis foto come from, @policenglagos
Di statement also add say:
"Di Lagos State Police Command go like to inform people for public say Damini Ogulu a.k.a 'Burna Boy' never still report imself to di police and e still dey hide and dat report wey dey spread for internet say di musician don honour police invitation no be true."
Di Command go like use dis opportunity to advise Burna Boy papa and relatives to do di right thing. Make dem bring di musician and hand am over give di police before di long arm of di law go catch am. Di command dey promise justice for dis matter."
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, @MR.2KAY
Wetin bring Burna Boy name for Mr 2Kay robbery matter?
Di Lagos State Police Commissioner, Edgar Imohimi, follow Channels TV talk recently, e say di CCTV cameras wey dey Eko Hotel and Suites show how dem take rob one musician Mr 2kay for im hotel room.
E say for about 2am, someone knock for Mr 2Kay room and introduce imself as room service official from di reception.
Mr 2Kay come open di door and four men enter with a gun.
Dey come thief im Audemais Piquet, one automatic gold wristwatch wey reach $25,000, gold jewellery wey reach N1.5m, iPhone 7 wey di value na N380,000, Samsung Galaxy S7, Samsung Galaxy S5, Adidas shoes, three bottles of perfume and N45,000.

Wia dis foto come from, @policenglagos
During di investigations, police arrest di girlfriend of one of di gang members.
Wetin she confess na im lead to di arrest of three people wey dem suspect say get hand for di robbery.
Dey come confess say one Damini Ogulu aka Burna Boy, wey be artiste, through im road manager, one Joel Kantiock, na im contact and pay dem to rob Mr 2Kay to teach am lesson.











