Cameroon: Fire go make parliament stop work until Monday

Cameroun parliament building for Yaoundé

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Cameroon parliament get two houses; di national assembly and senate
Read am in 1 mins

Parliament for Cameroon don postpone di work dem suppose do to Monday 20 November, after fire catch up to seven floors of di main building.

Di parliament main building bin catch fire on Thursday night and cause damage wey serious to parts of di house.

Nobodi know wetin cause di fire or whether any body die inside.

Local tori people dey carry say some MP's don begin talk how di fire affect dem.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Although di fire don off, di things wey burn inside plenty and normal person no fit use am.

President of Cameroon National Assembly Cavaye Yeguie Gibril, di Senate President and oda members of di parliament show for di glass house on Friday morning to see wetin and wetin spoil but dem not fit hold sitting.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Di fire happen four days after opposition lawmakers from the Social Democratic Front shun sitting because of di Anglophone palava inside di country.

On Monday 14 November 2016 na im di parliament begin new calendar year for di West Africa country.

Di parliament don begin consider four bills including di country budget since di parliament begin dia new calendar year dis week Monday but now dem don suspend sitting because of wetin happen.