World Prison record: Women prisoners don double

Wia dis foto come from, Reuters
Di number of Women prisoners around di world don increase by more than half since year 2000, according to di new report.
Na Institute for Criminal Policy Research for Birkbeck for University of London talk on Thursday say more than 714,000 women and girls na im dey inside prison around di world.
Dis new report dey come from di number four World Female Imprisonment List wey Roy Walmsley announce on Thursday 9 November 2017.
Di breakdown for dis report show say ni number of women and girls don grow faster pass ni number of men and boys wey dey prison since around the year 2000.
Di report show say even as di number of women and girls inside prison don increase by more than 50% di male population don increase by around 20%.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Top list of country dem wey get women and girls Prisoners pass
US211,870
CHINA107,131
End of Di one wey oda users dey read well well
RUSSIA48,478
BRAZIL44,700
INDIA41,119
MEXICO17,834
PHILIPPINES 12,658
VIETNAM 11,644
INDONESIA 11,465
MEXICO 10,832
MYANMAR 9,807
TURKEY 9,708
For di past two years since dem announce di last list, ni number of women and girls for Brazil, Indonesia, Philippines and Turkey don rise sharply even as di number don reduce well-well for Mexico, Russia Thailand and Vietnam.
From di list, America and China get di highest number of women and girls wey dey Prison.
Where Africa dey for dis list?
Upon all di number wey we call, women and girls make up 7% of di total number of people wey dey prison for di world.
For Africa, na only 3% of women and girls for di whole continent na im dey inside prison.
South Sudan dey lead with 11% of dia total population.
Wetin di report mean?
Catherine Heard wey be Director of Institute for Criminal Policy Research for di World Prison Research Programme, talk say di latest report on top di number of women and girls wey dey prison na cause for concern.
Catherine say dis matter dey happen for every continent, even for both developed and less developed countries.
Women and girls inside prison dey in danger because dem fit be victim of crime and abuse, di director talk.
She say make governments and prison administrations dey ask questions about wetin dey for dis data and how dem fit address dem.











