You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
S Africa rapper Emtee do mistake show imself for inside toilet
Popular South African rapper, Emtee, don make mistake show imself for inside toilet, as im dey talk to fans on top Instagram Live.
People for internet don dey laugh di rapper, wey im real name na Mthembeni Ndevu.
South Africa Times Live for internet talk say, with all di noise wey this 'accident' don cos, Emtee just dey chill for corner.
Emtee tell Times Live wetin happen, ''I dey toilet dey answer questions of fans for Instagram Live.''
''Di mistake l do na say, na di same hand wey di phone dey, I carry flush.''
''l no even think wetin l do until my eye clear and na quick-quick l say sorry.''
Entertainment website, ZAlebs, talk say people don dey do dia own version of wetin happen to Emtee and dem dey use di hashtag #emteechallenge.
ZAlebs add say this thing wey happen to Emtee fit be good thing.
End of Di one wey oda users dey read well well
''You don arrive when you do big mistake and dem start internet challenge on top of your head.''