Somalia Attack: Government don sack police and intelligence oga

Wia dis foto come from, Getty Images
Somalia government don sack di oga of police and intelligence after bomb blast on Saturday for di capital Mogadishu.
Dem comot police oga Abdihakin Dahir Saiid and di director of national intelligence, Abdillahi Mohamed Sanbaloosh, from office on Sunday.
Jihadist group Al Shabab say na dem carry out di attack, wey kill 27 people and injure many others.
Di government take di decision after one emergency cabinet meeting, na wetin officials talk.
Police say dem catch three of di militants alive, while two others blow demself die during di attack.
Di gunmen enter di building after two bombs tear di area on Saturday, 28 October, 2017.
Dis one dey happen just 10 days after big bomb blast kill pass 350 people for di country.
Wetin Happen

Wia dis foto come from, MOHAMED ABDIWAHAB/Getty Images
Tori be say di first explosion happen after car with bomb inside drive enter one hotel.
End of Di one wey oda users dey read well well
Small time, di second one come happen near di former parliament house.
E never dey clear how many people die and how many get injury, but one local ambulance service for Mogadishu talk say dem don carry fifteen people wey wound go hospital.











