Somalia explosion don kill almost 300 people - officials

Wia dis foto come from, Getty Images
Somalia don begin three days of mourning, as di number of those wey die for two bomb attacks for di capital Mogadishu don pass 276.
Abdirahman Osman, wey be di country minister for Information say na at least 300 other people injure.
Na on Sunday 15 October na im President Mohamed Abdullahi Mohamed Farmaajo declare di three days of mourning.
"We go mourn di innocent victims...dis na time to join hand, and pray together. Terror no go win," na wetin im talk.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
World leaders and di international community don put mouth inside di matter:
- Turkey say dem ready send planes with medicine and other things; dem wan still fly all people wey wound go Turkey for treatment
- Di African Union Commission president wey be Moussa Faki Mahamat say dem go continue to help Somalia "to get peace and security wey go last"
- UK Foreign Secretary Boris Johnson say im dey think of di victims' families and di government and people of Somalia. "Those wey do dis thing no respect human being life or think of di suffer-suffer wey di Somali people don see."
- UN Secretary General Antonio Guterres talk for Twitter say im dey feel sick by di attacks, and make everybodi join hand against terrorism.
- French President Emmanuel Macron still enter Twitter talk say France dey stand by Somalia on top dis matter.
Authorities say di number of those wey die fit still climb up, because work still dey go on.
Di first explosion happen inside di KM5 junction area for Mogadishu. Na so-so government offices dem, hotel and restaurants full there.
Di bomb destroy houses dem finish and plenty cars just dey burn dey go.
"Di number of those wey die must rise. We still dey move di dead bodi dem," Oga Abdullahi Nur, one police officer add put for di matter.
End of Di one wey oda users dey read well well
BBC Somali tori person Farhan Jimale bin enter Twitter to show small video of smoke wey full everywhere, as di explosion happen.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
E neva clear who do di attack but Mogadishu na constant target for al-Qaeda wey get hand with di al-Shabab group.
Al-Shabab dey fight di Somali government.