Davido: Nigeria police no fit say whether di star free

Wia dis foto come from, Instagram: @davidoofficial
Police don tell BBC News Pidgin say dem no fit use dia mouth confirm say Afrobeat musician, Davido, dey free from all di charge wey dey against am on top wetin happen when im friend Tagbo Umeike die.
Di singer dey under investigation, after Tagbo die on 3 October, because dat night photo and short video for social media show say di two of dem bin dey jolly together.
Now, local and social media for Nigeria don carry new tori from one of Davido Lawyer wey be Bobo F. Ajudua, wey claim say police don di free singer to go about im business, on to say im no dey guilty of di murder allegations against am.
But Lagos Police Public Relations Officer Olarinde Famous-Cole tell tori person Daniel Semeniworima today say im no dey aware say police don clear Davido.
"We still dey investigate di matter," na wetin Mr Famous-Cole talk.
Sharp-sharp informate about di Davido palava
Na on 12 October na im Lagos Commissioner of Police Imohimi Edgal bin tell tori people for Nigeria say di Afrobeat musician dey lie for di matter.
Meanwhile, Davido release statement and CCTV video di next day, wey im say im wan use prove say im no sabi anything concerning how im friend take die.
End of Di one wey oda users dey read well well
Before police chook eye for di matter, Nollywood actress, Caroline Danjuma wey be Tagbo girlfriend first accuse Davido, say im know something about Tagbo death.










