Nigeria: "I no lie say I no know wetin happen" - Davido

Davido

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Davido na popular musician wey don win plenty awards
Read am in 2 mins

Afrobeat musician, Davido, don release statement and CCTV video wey im wan use prove say im no sabi wetin happen when im friend Tagbo Umeike die.

Di CCTV video show Davido, Tagbo and some other people on 3 October for night club car park around 12:21 - 12:23 am.

Dis one na after Commissioner of Police Lagos, Imohimi Edgal on Wednesday say dem don tell Davido make im show for questioning because of new tori wey dem discover.

Edgal say dem don see new CCTV video wey show say na police car wey dey attached to Davido na im go drop Tagbo dead body for General Hospital for Lagos Island.

So dem wan know di person wey carry di dead body drop go dia and why di person do am.

Police say im die of suffocation.

But Davido say im no know anything about how Tagbo dead body take land for hospital.

Di video wey im release show Davido and Tagbo together for car park and e be like say Tagbo no balance, im dey stagger anyhow like person wey drink.

Later someone come help am waka back enter club.

Davido no follow am enter di club.

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 1

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 2

Skip Instagram post, 3
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 3

Davido also post letter from im lawyer Norrison Quakers wey talk say after Tagbo enter inside club, Davido comot dia go other places like Shisha Room, Oniru beach and DNA night club, where im hear say im friend Tagbo don die.

Skip Instagram post, 4
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post, 4

On top how di police car wey belong to Davido convoy come reach hospital? Di letter say na police and other friends of Tagbo drive am go dia.