You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nobel Prize 2017: ECOWAS dey shortlist for peace prize
Di first week of October na something wey top experts for world dey look forward to, because na dis time dem go know whether dem dey among winners of di Nobel Prize.
Di Nobel Prize na one of di biggest and most respected award for di world.
Na special committees for Sweden and Norway dey decide di people or organisations wey don achieve progress for di area of medicine, peace, economics, physics, chemistry or literature.
Among di people for world wey dey wait to hear di final result wey dem go announce this week na di Economic Community of West African States (ECOWAS).
This na because ECOWAS dey among those wey di organisers dey consider for di 2017 Nobel Peace Prize.
Na di Treaty of Lagos wey get 15 West African countries sign paper to gree form ECOWAS for 1975.
Since then, ECOWAS don dey put hand inside plenty peacekeeping missions for the region, including civil war for Sierra Leone, Liberia, Ivory Coast and Mali.
E never tay wey Gambia turn to ECOWAS when Yayha Jammeh wey don lead di country for 22 years refuse to recognize di result of di December 2016 election wey current president Adama Barrow win.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na soldiers from di West African regional military force enter di Gambia capital wey be Banjul, for January 2017 come finally make Mr Jammeh surrender, then fly comot di country.
Leaders from di group don meet regularly to talk about many-many palava way dey face di region these last few years, including security for Mali, di Ebola wahala for 2014 and di kidnap of over 200 schools girls for northern Nigeria.
Di group also to help stabilise Burkina Faso for 2015, when di former President of di ECOWAS commission, Kadre Desire Ouedraogo, ask di presidential guards to surrender weapon after attempt coup to remove interim President Michel Kafando.
Dem go announce di winner of di Nobel Peace Prize for Oslo on Friday, October 6, at 1100 a.m. (0900GMT).
Na after dis one dem go give di prize money, wey reach up to nine million Swedish crowns ($ 1.12 million), to di winner for 10 December 2017.
Three US scientists - Jeffrey Hall, Michael Rosbash and Michael Young - wey discover how our bodies dey tell time, go share di 2017 Nobel Prize for physiology or medicine.
Na Henrik Urdal, wey be di Director of di Peace Research Institute Oslo, for Norway dey make this shortlist wey don include ECOWAS among five other people and organisation for di Nobel Peace Prize.
Henrik Urdal im 2017 Nobel Peace Prize Shortlist
- Mohammad Javad Zarif and Federica Mogherini
- UNHCR and High Commissioner Filippo Grandi
- Cumhuriyet and Can Dündar
- The Economic Community of West African States (ECOWAS)
- The White Helmets and Raed al Saleh
Di Peace Research Institute Oslo (PRIO) na organisation of experts wey dey advice di Norwegian government on world mata.
Dis PRIO no get any direct connection with di Nobel Institute or Norwegian Nobel Committee wey go choose di winnesr.
Di Director of PRIO wey be Henrik Urdal, dey among small number of people for Norway wey fit nominate anybody or organisation for world.