Islam holiest site don start to dey Tweet

Wia dis foto come from, Twitter
Di Kaaba, wey be Islam's holiest site don start to dey tweet for im Twitter account.
Di Kaaba, wey mean "cube" na building wey dey di middle of di Grand Mosque for Mecca inside Saudi Arabia.

Wia dis foto come from, Twitter
Two days ago, one twitter account wey dey use di same name of di holy site, begin tweet. Di account name na @HolyKaaba and e dey verified.
@HolyKaaba account for Twitter
- Dem create am for March 2017
- First tweet na "Di Kaaba - peace symbol of Islam" for August 29.
- Followers for di account don pass 25,000.
- 14,000 people watch di first live video wey dem take Periscope do.

Wia dis foto come from, Twitter






