Cameroon vs Burkina Faso highlights: Indomitable Lions finish third for Afcon 2021 as dem beat Stallions 5-3 on penalties

Vincent Aboubakar dey celebrate wit team mate

Wia dis foto come from, Reuters

Cameroon don win di third place medal for di ongoing Africa Cup of Nations, Afcon 2021 afta dem beat Burkina Faso 5-3 on penalties.

Di Indomitable Lions bin come from behind, 3-0 down to draw 3-3 with di Stallions at di end of full time.

Na di second time for di ongoing 2021 Africa Cup of Nations, wey hosts Cameroon meet wit Burkina Faso.

Unlike wen dem meet for group stage, dis time di Bronze medal bin dey at stake to crown di team wey go finish third for Afcon 2021.

Wen dem bin first meet for di opening fixture of di tournament, di Indomitable Lions come from behind to defeat di Stallions 2-1 for di Ahmadou Ahidjo Stadium.

Hosts, Cameroon bin dey hope to compensate dia kontrimen afta dem lose 3-1 on penalties to Egypt for di semi-final.

Di wounded Indomitable Lions don play for two, third-place play-off match - dem don win one and lose di oda.

Meanwhile Burkina Faso bin dey all out for revenge and to make sure dem no lose to Cameroon two times for di same competition.

Coach Kamou Malo bin dey confident of di progress di Stallions bin don make despite dia 3-1 semi-final defeat against Senegal. Dat match na di third time wey Burkina Faso go make semi-final for di last four Afcon.

Di Stallions bin dey hope to secure anoda third-place finish like dem bin do for 2017 Afcon wia dem beat Ghana 1-0.

Di match take place for di Stade Ahmadou Ahidjo for Yaoundé and e start by 20:00 GMT.

See how di match hapun live.

Burkina Faso vs Cameroon

Wia dis foto come from, Getty Images

Live Updates

First Half

Kick - Off!

2 mins: Offside, Cameroon. Olivier Mbaizo try one through ball, but e catch Stéphane Bahoken offside.

5 mins: Foul by Issa Kaboré (Burkina Faso).

5 mins: Ignatius Ganago (Cameroon) win free kick for di defensive half.

7 mins: Stéphane Bahoken (Cameroon) win free kick for di defensive half.

9 mins: Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) header from di left side of di box miss go left. E bin dey assisted by Issa Kaboré with di cross.

10 mins: Ismahila Ouédraogo (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

11 mins: Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) right foot shot from outside di box dey saved for di bottom left corner. E dey assisted by Djibril Ouattara.

13 mins: Pierre Kunde (Cameroon) win free kick for di right wing.

13 mins: Blati Touré (Burkina Faso) commit foul.

14 mins: Farid Ouédraogo (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

14 mins: Jean Onana (Cameroon) commit foul.

15 mins: Burkina Faso. Farid Ouédraogo try one through ball, but e catch Djibril Ouattara offside.

Ambroise Oyongo (Cameroon) win free kick for di left wing.

Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) commit foul.

18 mins: Dem save Jean Onana (Cameroon) left foot shot from di centre of di box for di centre of di goal.

22 mins: Jean Onana (Cameroon) right foot shot from di centre of di box go too high. Na Ambroise Oyongo assist with di cross.

24 mins: Issa Kaboré (Burkina Faso) win free kick for di right wing.

Stéphane Bahoken (Cameroon) commit foul.

24 mins: GOAL!

Burkina Faso 1, Cameroon 0. Steeve Yago (Burkina Faso) left foot shot from di left side of di six yard box to di high centre of di goal. Na Issa Kaboré provide di assist with di cross.

27 mins: Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) commit foul.

André Onana (Cameroon) win free kick for di defensive half.

30 mins: Foul by Bertrand Traoré (Burkina Faso).

Ambroise Oyongo (Cameroon) win free kick for di defensive half.

34 mins: Corner for Burkina Faso. Na Jérôme Onguéné concede am.

38 mins: Hand ball by Stéphane Bahoken (Cameroon).

39 mins: Foul by Abdoul Tapsoba , Burkina Faso.

Olivier Mbaizo (Cameroon) win free kick for di defensive half.

Blati Touré (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

Pierre Kunde (Cameroon) commit foul.

42 mins: Cameroon. Olivier Mbaizo try one through ball, but e catch Christian Bassogog offside.

Ignatius Ganago (Cameroon) left foot shot from di left side of di box dey blocked.

GOAL!

43 mins: Own Goal by André Onana, Cameroon. Burkina Faso 2, Cameroon 0.

45 mins: VAR Decision: Goal Burkina Faso 2-0 Cameroon (André Onana).

45+2 mins: Burkina Faso Blati Touré try one through ball, but e catch Djibril Ouattara offside.

Issa Kaboré (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

Foul by Ignatius Ganago (Cameroon) commit foul.

45'+3' mins: Steeve Yago (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

Christian Bassogog (Cameroon) commit foul.

45+5 mins: Half Time

Burkina Faso 2, Cameroon 0.

Burkina Faso players celebrate

Wia dis foto come from, Getty Images

Second Half

45 mins: SUBSTITUTION

Cameroon. Vincent Aboubakar replace Samuel Oum Gouet.

Nicolas Moumi Ngamaleu replace Ignatius Ganago.

47 mins: Gustavo Sangaré (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

Stéphane Bahoken (Cameroon) commit foul.

48 mins: Stéphane Bahoken (Cameroon) collect yellow card for bad foul.

49 mins: GOAL!

Burkina Faso 3, Cameroon 0. Djibril Ouattara (Burkina Faso) header from di centre of di box to di bottom right corner. Na Bertrand Traoré assist am with di cross.

52 mins: Gustavo Sangaré (Burkina Faso) left foot shot from outside di box no meet target.

Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) commit foul.

Ambroise Oyongo (Cameroon) win free kick on di left wing.

52 mins: Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) collect yellow card for bad foul.

53 mins: Jérôme Onguéné (Cameroon) right foot shot from outside di box dey too high. E dey assisted by Stéphane Bahoken afta one set piece.

54 mins: Substitution, Cameroon. Karl Toko Ekambi replace Christian Bassogog.

54 mins: Blati Touré (Burkina Faso) win free kick for di defensive half.

Vincent Aboubakar (Cameroon) commit foul.

56 mins: Corner to Cameroon. Na Ismahila Ouédraogo concede am.

Vincent Aboubakar (Cameroon) header from di centre of di box dey just too high. E dey assisted by Nicolas Moumi Ngamaleu with di cross afta di corner.

57 mins: Gustavo Sangaré (Burkina Faso) commit foul.

Jean Onana (Cameroon) win free kick or di defensive half.

58 mins: Djibril Ouattara (Burkina Faso) commit foul.

Harold-Desty Moukoudi (Cameroon) win free kick for di defensive half.

61 mins: Corner to Cameroon. Na Issa Kaboré concede am.

62 mins: Blati Touré (Burkina Faso) commit foul.

Karl Toko Ekambi (Cameroon) win free kick for di defensive half.

Abdoul Tapsoba (Burkina Faso) commit foul.

Nicolas Moumi Ngamaleu (Cameroon) win free kick for di attacking half.

63 mins: Post update

Jérôme Onguéné (Cameroon) win free kick for di attacking half.

Gustavo Sangaré (Burkina Faso) commit foul.

64 mins: Harold-Desty Moukoudi (Cameroon) header from di centre of the box go too high. E bin get assist from Pierre Kunde afat one set piece.

Djibril Ouattara (Burkina Faso) win free kick for di right wing.

Harold-Desty Moukoudi (Cameroon) commit foul.

65 mins: Steeve Yago (Burkina Faso) commit foul.

Nicolas Moumi Ngamaleu (Cameroon) win free kick for di defensive half.

Karl Toko Ekambi (Cameroon) right foot shot from di left side of di box dey blocked. E dey assisted by Vincent Aboubakar.

67 mins: Ismahila Ouédraogo (Burkina Faso) commit foul.

Karl Toko Ekambi (Cameroon) win free kick on di left wing.

68 mins: Ismahila Ouédraogo (Burkina Faso) collect yellow card for bad foul.

Karl Toko Ekambi (Cameroon) collect yellow card.

Harold-Desty Moukoudi (Cameroon) right foot shot from di centre of di box dey blocked.

70 mins: Jean Onana (Cameroon) left foot shot from outside di box dey blocked. E dey assisted by Nicolas Moumi Ngamaleu.

71 mins: Corner to Cameroon. Na Edmond Tapsoba concede.

Harold-Desty Moukoudi (Cameroon) header from di centre of di box come close, but e miss am to di right.

Karl Toko Ekambi (Cameroon) header from very close range also dey blocked. E bin dey assisted by Harold-Desty Moukoudi.

71 mins: GOAL!

Burkina Faso 3, Cameroon 1. Stéphane Bahoken (Cameroon) right foot shot from very close range to di centre of di goal afta one corner.

73 mins: Dem save Karl Toko Ekambi (Cameroon) right foot shot from di left side of di box for di top centre of di goal.

Corner to Cameroon. Na Farid Ouédraogo concede am.

Edmond Tapsoba (Burkina Faso) collect yellow card for bad foul.

75 mins: Jean Onana (Cameroon) right foot shot from outside di box go high and wide to di right. Na Vincent assist.

Djibril Ouattara (Burkina Faso) win free kick for di attacking half.

Foul by Jérôme Onguéné (Cameroon).

77 mins: Edmond Tapsoba (Burkina Faso) right foot shot from outside di box miss to di left. Na Bertrand Traoré provide di assist afta one set piece.

79 mins: Foul by Issa Kaboré (Burkina Faso).

Harold-Desty Moukoudi (Cameroon) win free kick for di defensive half.

81 mins: Ambroise Oyongo (Cameroon) left foot shot from di left side of di box dey saved for di bottom left corner.

85 mins: GOAL!

Burkina Faso 3, Cameroon 2. Vincent Aboubakar (Cameroon) header from di centre of di box to di bottom left corner. E dey assisted by Nicolas Moumi Ngamaleu with a cross following a corner.

86 mins: Substitution, Burkina Faso. Eric Traoré replace Abdoul Tapsoba.

Burkina Faso. Hassane Bandé replace Bertrand Traoré.

87 mins: GOAL!

Burkina Faso 3, Cameroon 3. Vincent Aboubakar (Cameroon) right foot shot from di centre of di box to di bottom left corner.

90+4 mins: Substitution, Burkina Faso. Mohamed Konaté replace Djibril Ouattara.

Burkina Faso. Aboubacar Sawadogo replace Farid Ouédraogo because of injury.

90+5 mins: Mohamed Konaté (Burkina Faso) win free kick for di attacking half.

Foul by Pierre Kunde (Cameroon).

Eric Traoré (Burkina Faso) header from di centre of di box miss to di left. E dey assisted by Blati Touré afta set piece situation.

90+6 mins: Foul by Blati Touré (Burkina Faso).

Jean Onana (Cameroon) win free kick for di attacking half.

90+9 mins: 90'+9'

Burkina Faso players celebrate second goal

Wia dis foto come from, Getty Images

Full Time

Second Half don end, Burkina Faso 3, Cameroon 3.

Penalty Shoot-0ut

90+1 mins: Vincent Aboubakar take first penalty for Cameroon. E score.

90+1 mins: Issa Kaboré take first penalty for Burkina Faso. E score.

90 +2 mins: Nicolas Moumi Ngamaleu take di second one for Cameroon. E score.

90+3 mins: Soumaila Ouattara take second for Burkina Faso. E score.

90+4 mins: Toko Ekambi take di third one for Cameroon. E score.

90+5 mins: Penalty saved! Blati Touré take di third one for Burkina Faso. E fail to convert am, di keeper save im right foot shot for di bottom right corner.

90+6 mins: Pierre Kunde take di fourth one for Cameroon. E score.

90+7 mins: Steeve Yago take di fourth one for Burkina Faso. E score.

90+8 mins: Ambroise Oyongo take di fifth one for Cameroon. E score.

Cameroon win 5-3 on penalties!