Burkina Faso vs Senegal: Highlights of di Afcon 2021 semi final game

Senegal beat Burkina Faso 3 -1 to book dia spot for di Afcon 2021 final.

Senegal bin dey hope to make dem sef back-to-back Afcon finalist afta dia loss to Algeria for 2019.

Di match hold for Stade Omnisport Ahmadou Ahidjo for Yaounde and kick-off na 7pm GMT.

Di two West African kontris bin don reach Afcon final before but none of dem don win am.

Senegal start slow on dia way to di semi-final but dem score more goals for di quarter finals.

Also, Burkina Faso wit dia young team also beat Tunisia to enta semi final.

Di Burkina Faso vs Senegal dey unpredictable but eye go dey on top Liverpool forward Sadio Mane to show im sef but di Burkinababe go miss dia 19 year old striker Dango Ouattara.

But Burkina Faso go depend on dia strong defence to stop di attacking speed of Senegal.

See how di match dey go live.

Live updates

KICK-OFF

I min: Burkina Faso 0-0 Senegal

Di first of di two semi-finals don start!

2 mins: Burkina Faso get di first shot on goal but but na wayward shot wey Bertrand Traore launch wey go high and wide.

4 mins: Two pipo jam head togeda. Nampalys Mendy and Cyrille Bayala clash as two of dem go for di ball. Complete accident but both of dem dey down and in pain.

7 mins: Dem don carry Nampalys Mendy comot ontop stretcher and e no look good for di Leicester midfielder.

Sadio Mane win free kick on di pitch but e go left, e no do anytin.

9 mins: Full-back Steeve Yago break down di flank, e skip pass one challenge before e give am to Bertrand Traore, wey im shot from di edge of di area no work out.

11 mins: Afta dem carry am comot on stretcher Nampalys Mendy don recover from dat clash of heads and e don come back di pitch as Famara Diedhiou win Senegal one corner.

12 mins: Di corner no be di best and Bertrand Traore head am away for di near post and dem deal wit di danger for Burkina Faso.

14 mins: Very close. Good moment for Senegal as Saliou Ciss cut in from di left and sweep one low effort just wide of di far post.

Na di closest we don see so far.

16 mins: Senegal dey do some tins down di left as Saliou Ciss and Sadio Mane dey cause plenty of problems. E dey look like di most likely area wia goal go come from for dem at di moment.

18 mins: Cheikhou Kouyate cross from di right almost catch out di goalkeeper as e float towards goal but Herve Koffi get back onto im line to make di catch.

Burkina Faso den break as Bertrand Traore get into di Senegal area but im shot no strong.

21 mins: Anoda good break by Burkina Faso as one cross from di right almost get through to Bertrand Traore but dem clear am behind for corner.

Di set piece amount to nothing.

24 mins: One Senegal corner meet Famara Diedhiou, but im first-time shot dey cleared off di line by Edmond Tapsoba.

26 mins: Senegal keep up di pressure as Bamba Dieng send across one header but e no click.

Anoda danger come from down di left as Saliou Ciss send a cross in.

PENALTY TO SENEGAL

Herve Koffi charge come off from im line to meet a high ball into di box and crash enta Cheikhou Kouyate. Di referee quickly point to di spot!

31 mins: Na long wait for dis penalty because Cheikhou Kouyate need treatment afta dat clash.

VAR still dey chook eye for di penalty decision and di referee dey head over to di pitchside monitor as dem use stretcher to carry Cheikhou Kouyate comot.

33 mins: Video Assistant Referee - no penalty

Referee Bamlak Tessema Weyesa reverse im on field decision and now come award a drop ball, no be penalty!

35 mins:

SUBSTITUTION

Cheikhou Kouyate idey able to continue for Senegal but Burkina Faso go lose dia first-choice goalkeeper here as dem replace di injured Herve Koffi.

36 mins: Senegal lose di ball for dia own half and once again Burkina Faso move quickly to win themselves anoda corner but di delivery dey headed away.

38 mins: Dem tackle Bertrand Traore inside di box but the ball manage pass through to Hassane Bande, but Edouard Mendy push behind im shot.

PENALTY APPEAL

Sadio Mane break into the box and Issa Kabore do one anyhow challenge but di referee no see enough contact to award a penalty.

45 mins: Dem add on six minutes according to wetin di fourth official show for im board.

45+2 mins: Burkina Faso don get some few corners for dis half but dme never make di most of dem and dem decide to mix tins up with dia latest one. But e still no work.

45+5 mins: Senegal dey finish dis half strongly as Bamba Dieng smash over from one tight angle before Sadio Mane shot dey pushed behind by substitute keeper Farid Ouedraogo.

PENALTY TO SENEGAL

Senegal get anoda penalty right as di half time dey around di corner as dem dey chook eye for Edmond Tapsoba say e block shot with im hand.

Di referee overturn im original decision afta e chook eye again wit VAR.

E also take back di yellow card for Edmond Tapsoba, wey mean say e fit play for di final if dem reach.

HALF-TIME

Burkina Faso 0-0 Senegal

Half time whistle don sound.

No goals but plenty of drama for di first half.

SECOND HALF

46 mins: KICK-OFFE

Second half don start.

48 mins: PSG defender Abdou Diallo dey ontop di situation as e deal with di danger from anoda quick Burkina Faso break, as Bertrand Traore bin dey hope to force im way through.

50 mins: Sadio Mane and Saliou Ciss combine on di left but di play into di box na poor one.

51 mins:

YELLOW CARD

Bouna Sarr collect as e slide in enta Adama Guira.

54 mins: Burkina Faso manager dey vex for di touchlines afta one poor final ball end in a disappointing way.

Very close one for Burkina Faso as Bertrand Traore pursue di ball over di top but Kalidou Koulibaly get am back shaparly to hook di ball back ontop Traore face and outside for a goalkick.

59 mins

SUBSTITUTION

Burkina Faso dey make anoda change because Cyrille Bayala comot with injury. Dem replace am wit Zakaria Sanogo.

61 mins: Senegal get free kick but dem head away Saliou Ciss' ball wey im play into di box.

63 mins: SUBSTITUTION

Senegal make double change as Famara Diedhiou dey replaced by Watford striker Ismaila Sarr while Pape Gueye replace Cheikhou Kouyate.

65 mins: Abdou Diallo head comot ball into di box by Burkina Faso.

67 mins: Burkina Faso get corner but na easy one to stop for Edouard Mendy.

70 mins: GOAL!

GOAL - Burkina Faso 0-1 Senegal

Abdou Diallo wit di goal for Senegal.

Di ball dey sent towards di goal by Kalidou Koulibaly and im defensive partner Abdou Diallo touch am before e put am in from close range.

75 mins: GOAL!

Sadio Mane get di ball on di left afta dem collect possession from a defender and e dribble am into di area before e feed to di middle of di box where Idrissa Gueye finish am.

Second goal for Senegal.

77 mins: SUBSTITUTION

Senegal make a third change afta di goal as Bamba Dieng make way for Pape Sarr.

80 mins: SUBSTITUTION

Burkina Faso make some changes. Djibril Ouattara come on for Adama Guira while Abdoul Tapsoba replace Boureima Bande.

81 mins: GOAL - Burkina Faso 1-2 Senegal

Burkina Faso no give up yet as Blati Touré put in a cross from di right.

Dat na Touré first goal for im kontri and a big one too as now dem get hope.

Game on!

84 mins: Burkina Faso coaching team dey vex say dem feel say dem suppose get a penalty for handball. But from di replay e be like say e bounce off Pape Sarr chin rather dan im hand.

87 mins: GOAL - Burkina Faso 1-3 Senegal

Sadio Mane put in a record-equalling goal!

Senegal main man run wuit di ball before wen e get am before e calmly put am over di goalkeeper.

Dat na di Liverpool striker 29th goal for im kontri, e make am Senegal joint all-time top scorer.

90 mins: Na three additional minutes as Senegal close in on dia place for di final.

90+1 min : SUBSTITUTION

Senegal make a late change as Nampalys Mendy dey replaced by Pape Abou Cisse.

FULL TIME!

Burkina Faso 1-3 Senegal

E don finish.

Senegal dey through to di Africa Cup of Nations final!