Nigeria vs Egypt Highlights: Kelechi Iheanacho goal give Super Eagles victory over Mohammed Salah Pharaohs

Omeruo and Salah

Wia dis foto come from, Getty Images

Kelechi Iheanacho goal help Nigeria win di Pharaohs of Egypt.

Three time Afcon winners Nigeria Super Eagles tackle seven time winners pharaohs of Egypt for Estadio Roumde Adjia on Tuesday for match wey many say fit be di biggest game for di ongoing Nations Cup for Cameroun so far.

Dis na Eagles 19th appearance for Afcon tournament and dem dey try to win dia fourth trophy, dia opponents Pharaohs dey make dia 23rd appearance.

Egypt dey hope to get dia eight trophy.

Both teams dey look forward to di FIFA world cup in Qatar as dem already progress to di next round of qualifiers.

How di match take waka

Egypt take di first kick

1' - Egypt captain Mohammed Salah take di first kick of di game as di refereee blow di whistle to signal di start of di match.

4' - Chance for Egypt

Mostafa Mohammed test Nigeria goalkeeper, Okoye wit di first shot of di game.

Di Galatasaray striker shot from di right dey weak as Okoye comfortably catch am.

7' Akram Tawfik need medical attention

Egypt player Akram Tawfik need medical attention as im signal to di bench say im dey in pain.

Di extent of im injury dey yet to be discovered as di medical team attend to am

12' Early substitution for Egypt

Coach Carlos Queiroz decides to make substitution as Akram Tawfik no go fit kontinu

Mohamed Abdelmonem don replace di injured right back.

Okoye come out early to stop Egypt move

Mohamed Salah wey look like say im dey offside give through pass into di box for Trezeguet, but Maduka Okoye show good awareness to stop am.

14' Okoye come out early to stop Egypt move

Mohamed Salah wey look like say im dey offside give through pass into di box for Trezeguet, but Maduka Okoye show good awareness to stop am.

21' Change of ball

Nigeria striker Taiwo Awoniyi make strong challenge wey referee Bakary Gassama no like as im blow for foul.

Meanwhile sometin dey wrong wit di football as di referee don ask make dem change am.

26' Moses Simon chance!

Nigeria midfielder Moses Simon shoot shot wey hit side neeting afta Joe Aribo lay through pass for am.

So far di match still be Nigeria 0-0 Egypt.

39' Ndidi try im luck from distance

Samuel Chukwueze make dancing run into Egypt half wia im come fine Wilfred Ndidi wit pass.

Di midfielder left foot attempt from outside di box drift wide as El Shenaawy fit only watch di ball go ova.

Nigeria still dey press egypt so far.

El Shanawy save!

Egypt goalkeeper El Shenawy save end sweeping move for Nigeria as im save di shot from Taiwo Awoniyi.

Goal for Nigeria!

Leicester City striker Kelechi Iheanacho give Nigeria di lead.

Aribo head di ball to Iheanacho after Egpt block Simon cross, 'Seniorman' come fire wonderful half-volley into di roof of di net!

Kelechi Iheanacho goal don wake up di Pharaohs as Ahmed El Fotouh whip in promising cross into di box, but di opposition defence intercepts the ball.

Afta 36mins Nigeria dey lead 1-0

Moses Simon dey worry Egypt

Abdelmonem dey experience tough time as Nantes mdfileder Moses Simon dey cause am problems for right-back.

Referee add three minutes added time before di first half go end.

Half time: Nigeria 1-0 Egypt

Referee Bakary Gassama blow di whistle to end di first half.

So far Nigeria dey lead 1-0 thanks to 30th minute goal from Kelechi Iheanacho

Second half don start

Egypt make half-time substitution as coach Queiroz bring ON Ayman Ashraf for Ahmed El Fotouh.

Nigeria pass di ball as di second half don start.

48' Nigeria hit di bar!

Nigeria striker Taiwo Awoniyi near post header hit cross bar afta save from Taiwo Awoniyi.

52' Awoniyi head corner wide

Awoniyi jump high to connect wit Moses Simon cross but im header go wide.

57' Iheanacho miss control deny Nigeria chance of second goal

Nigeria right back Ola Aina make good run into di box as di Egypt defenders no fit stop am but im push di ball too much as Hegazy block am finally.

But di ball land for Iheancho wey im first touch let am down as im bin get good chance to increase Nigeria lead.

Substitutions for Egypt

Egypt make dia third and fourth substitution.

Trezeguet OFF, Zizo ON

Mostafa Mohammed OFF, Ramadan Sobhi ON

63' Aina try im luck from outside

Aina look to double Nigeria lead as im decide to take matters into im hands.

But im ambitious shot from 20-yards fly well ova di bar.

65' Nigeria come close to score second

Iheanacho almost score im second of di game from Wilfred Ndidi pass.

Di 25-year-old strong left shot go wide as Egypt defence look troubled.

67' Zizo shot dey blocked

Egupt substitute Zizo find himself beyond Nigeria last defender, but di referee stop di game afta di linesman signal for offside.

Later on Aina use body block Zizo volley as Egypt don begin to press Nigeria.

71' Salah Chance!

Mohammed Salah beat di Nigeria offside trap as im run wit di ball towards Maduka Okoye, di Liverpool man poor shot dey tame as Zaidu Sanusi clear di ball from going in.

72' Nigeria make subsitutions

Super eagles don make two substitutions as Sadiq Umar don come ON for Taiwo Awoniyi.

Chidera Ejuke don also replace Samuel Chukwueze.

76' Ejuke test El Shanawy

Chidera Ejuke wey just come on for Nigeria don test di palms of El Shanawy.

Di moscow-based midfielder receive pass froom deep inside di box, im control am come shoot shot but El Shanawy bin dey dia to save am.

78' Omeruo injured

Di medical team don carry Omeruo comot from field as im no fit continue di game. E no dey clear wetin happun to di Leganes defender but Ajayi don come ON to replace am.

Coach Austin Eguavoen also send on Kelechi Nwakali to replace di goalscorer Iheanacho

83' Corner kick to Egypt

Egypt win corner kick afta Aina head Abdelmonom cross out of corner kick.

From di corner wey Zizo take, Hegazy looping shot bin dey too high to dey on target as Okoye watch di ball go out for goal kick.

90' Nigeria make substitution

Nigeria make dia fifth and final substitution as Alex Iwobi come ON for di impressive Moses Simon.

Di referee don add four minutes extra time.

90+2 Ejuke missed chance!

Super Eagles counter Egypt wit di Pharaohs defence open.

Chidera Ejuke play one-two wit Nwakali but di winger surging run and shot dey saved by El Shanawy.

Full Time: Nigeria 1-0 Egypt

E don finish!

Nigeria vs Egypt: Super Eagles starting lineup

Okoye; Aina, Troost-Ekong, Omeruo, Aina; Onyeka, Ndidi, Aribo; Chukwueze, Iheanacho, Awoniyi

Nigeria vs Egypt: Pharaohs starting lineup

El-Shennawy; Akram, El-Wensh, Hegazi, Fetiouh, Hamdi, Elneny, Trezeguet, Salah, Marmoush, Mostafa.