Manchester United v Man City: Ole Solskjaer Red Devils collect 2 - 0 beating from di Citizens for Old Trafford

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City use Manchester United play ten-ten for di latest match up for di Premier League in front of home fans for Old Trafford.
E shock plenti pipo no be small wit di 2 - 0 defeat.
In fact many pipo dey wonder wetin coach Solskjaer dey do sake of say, Man U neva lose dia derby for di last four games.
Na Eric Bailly first spoil tins for di Devils wit own goal - e just turn Joao Cancelo cross into im own net afta seven minutes.
Bernardo Silva come knack United akpako wen e net di second goal to secure di win for City.
In fact, if no be be say David Gea bin do some kain beta beta saves, wit di way di Citizen dominate di match, many pipo believe say di scoreline for plenti pass.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di second half of di game just be like say United players no understand wetin dey play as City just just dey move ball up and down di field like say dem wan tear dia opponent net.
As e be so, eyes go dey United to know wetin go be di future of coach Ole Gunnar Solskjaer sake di poor to average performance of di team dis season.
End of Di one wey oda users dey read well well











