Naomi Osaka: Japanese tennis player Osaka pull out of French open 2021 - See oda similar experience
!["Naomi Osaka": Japanese tennis player [Osaka pull out of French open 2021]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/5286/production/_118762112_naomiosakajapanesetennisplayer-osakapulloutoffrenchopen2021.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
E no longer be news say tennis star Naomi Osaka don comot from French Open.
Naomi Osaka pull out of di tournament after first round sake of her disagreement with organisers about media tok-tok.
Di tennis star say her reason na mental health concerns.
But di French Open organisers maintain say na important duties for stars to face media before and after matches.
No be Naomi Osaka be first, some top stars don do dis kain tin before her.
Rory Mcilroy
Dis Irish golf star seriously enjoy di 2012 and 2013 golfing season winning several trophies but di following year no start well for am.
Rory Mcilroy quit di 2013 Abu Dhabi Masters tournament in di middle of competition citing tooth ache as reason.
End of Di one wey oda users dey read well well
!["Naomi Osaka": Japanese tennis player [Osaka pull out of French open 2021]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/12882/production/_118760957_naomiosakajapanesetennisplayer-osakapulloutoffrenchopen2021.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Other
Sol Campbell
Dis former Arsenal defender mistake lead to im team conceding two goals against West Ham for 2006 premier league match.
During half time, Sol Campbell drive im car dey go house instead of going to di dressing room for half time tok.
Na after 10 months Campbell return and like Osaka na mental health be di reason.
!["Naomi Osaka": Japanese tennis player [Osaka pull out of French open 2021]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/14F92/production/_118760958_naomiosakajapanesetennisplayer-osakapulloutoffrenchopen2021.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Mike Tyson
For 2005 when di legendary boxer Mike Tyson return to ring e face Kevin Mcbride wey be underdog for di fight.
And as di match dey wan enter 7th round Tyson quit because of exhaustion.
Before then e don tey wey di boxer enter ring and di rustiness show for im performance.
Im decision to quit make di referees make im opponent di winner.
Naomi Osaka profile
Japan tennis player Naomi Osaka don become di highest paid female athlete for di world.
22 years old Osaka wey be two time Grand slam champion get money now pass Serena Williams.
She make £30.7m in di past 12 months from endorsement deals and tournament prize money, according to Forbes magazine.
Dat na £1.15m more than di amount wey 38-year-old Williams earn.
Both shattered the previous single-year earnings record of £24.4m set in 2015 by Russia's Maria Sharapova.
Since Forbes began tracking women athletes' income in 1990, tennis players na im dey top di annual list evri year.
Osaka, wey her papa dem born am for Haiti and whose mama na Japanese, na di 29th on top 2020 Forbes list of di world's 100 top-paid athletes, four spots ahead of Williams, wey don win winner of 23 Grand Slam singles titles.





!["Naomi Osaka": Japanese tennis player [Osaka pull out of French open 2021]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/176A2/production/_118760959_naomiosakajapanesetennisplayer-osakapulloutoffrenchopen2021.jpg.webp)






