Arsenal vs Fulham: Eddie Nketiah late goal save Arsenal from home defeat

Eddie Nketiah

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Eddie Nketiah score e second league goal dis season for Arsenal to rescue one point for di gunners

Arsenal striker Eddie Nketiah injury-time goal help Arsenal rescue one point against Fulham for Premier League.

Nketiah wey come on as second half substitute tap in rebound shot for di 97th minute of added time to equalise for Arsenal.

Di Gunners been dey trail Fulham for di most part of di second half after Nigerian striker Josh Maja bin put Fulham ahead for di from di penalty spot.

Maja goal na di only shot on target wey Fulham bin record for di match wey Arsenal dominate possession but produce little end product.

Fulham now dey six points away from safety - and dem don play two games more than Burnley and Brighton, di two teams wey dey above dem for table.

'Inconsistent Arsenal'

After dem dismante Slavia Prague on Thursday, di outcome of dis fixture don really show very little to comot di feeling of unpredictability wey surround Arsenal.

On paper, Mikel Arteta go don expect to see im side defeat dia struggling opponents with few difficulties.

But dia up-tempo start, wey see Gabriel Martinelli twice go close to scoring, soon fade out.

VAR also contribute to Arsenal failure to break di deadlock as Ceballos see VAR rule out im header after dem judge Saka to dey centimetres offside for di build-up.

To dia credit Arsenal persevere after dem fall behind despite say Alexandre Lacazette limp off after 70 minutes injured.

And a late siege see Nketiah, Saka, Gabriel and Martinelli all get efforts on goal before di dominance finally bear fruit.

Disappointment for Fulham

Already seven points behind safety, to settle for just one point for dis game go pain di players and staff of di club as dem bin don almost win di match.

Despite say dem bin no create much, Fulham defend well and bin dey fortunate to go ahead after di referee award dem penalty. Arsenal defender Gabriel foul inside di box present Maja di opportunity for Fulham to take di lead, one wey im convert smoothly.

Wit only six games remaining now before di season end, Fulham go need pick demself up from dis disappointment ahead of dia next game against Chelsea.