Afcon qualifier results: Comoros, Gambia make history as dem qualify for Africa Cup of Nations

Comoros fans

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Comoros fans celebrate long into di night on Thursday afta dia team historic qualification
Read am in 1 mins

Comoros make history on Thursday wen dem draw 0-0 for dia home to Togo to qualify for di Africa Cup of Nations for di first time.

Dem now dey celebrate one of di biggest achievements for di kontri wey don dey more famous for dia history of political coups and music than any sporting success.

Wild scenes of celebration bin happun wen di ref blow di final whistle as fans, players and politicians begin celebrate di shock qualification for next year finals for Cameroon.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Comoros bin never win any major qualifier until 2016 wen dem beat Botswana for wetin be dia 20th attempt to win either Nations Cup or World Cup qualifier.

Five years on, they are top of Group G - featuring record African champions Egypt no less - with three wins and two draws from their five matches.

Gambia secure dia first appearance when Assan Cessay goal for di 62nd minute seal dia 1-0 win over Angola.

Oda teams wey also don qualify

Perennial title contenders Egypt don also secure dia spot for Cameroon, alongside Tunisia, Mali, Guinea, Burkina Faso, Gabon, Zimbabwe, Equatorial Guinea and reigning champions Algeria.

Ghana, Gambia, Senegal also don qualify for di tournament wey Caf bin postpone due to coronavirus.