Fifa ban on Ahmad go make oda African kontris sharp teeth for Caf 2021 presidency

Wia dis foto come from, FADEL SENNA
Confederation of African Football (Caf) president Ahmad don chop five years ban from Fifa for breaching dia code of ethics.
Di Fifa vice-president, age 60, break rules relating to duty of loyalty, offering and accepting gifts abuse of position as well as misappropriation of funds.
Oga Ahmad, wey BBC Sport Africa tok about im possible ban last month, also chop fine of $200,000.
Ahmad Ahmad don deny all di accuse dem.
Last month, di Fifa vice-president from Madagascar announce him intention to go for a second term for office wen Caf elections take place next March.
Dis now na big comma for am now as im gatz pass eligibility test to resume im place for Fifa Council.

Wia dis foto come from, GULSHAN KHAN/Getty Images
Wetin Fifa tok?
"Di investigation into Oga Ahmad behaviour... from 2017 to 2019 relate to many Caf governance mata, including di organisation and financing of one Umrah pilgrimage to Mecca, im role inside Caf business wit sports equipment company Tactical Steel and oda activities," according to di Fifa statement.
Fifa also fine Ahmad $200,000.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga wey many bin expect say go run second term as Caf president, bin deny di accuse and even now e get right to appeal di ban, if im want.
Otherwise, di March 2021 Caf presidency go rest on di shoulders of oda candidates.
Wetin go happen next?
In situations like dia, wia Fifa don ban lead of continental or a kontri footbal oga, di global joinbodi demsef go take over on a temporary basis.
At least until new leader come out either through voting or appointment.
For African football, Senegalese executive Fatma Samoura, wey also be Fifa Secretary-General na im don dey run affairs for di continent. And e be like dis temporary arrangement go continue until March elections.
Who else fit contest Caf presidency?

Wia dis foto come from, Getty Images
Amaju Pinnick - Nigeria
As at September 2021, di head of Nigeria Football Federation (NFF) bin tok am openly say im dey eye to run for Caf presidency although e admit say before before im follow for pipo wey desire for Ahmad to do pass one term.
"From di beginning di idea na to have incumbent Ahmad get re-election for a second tenure or even third tenure," Pinnick tell BBC Sport Africa.
But e be like say as water come dey pass garri for Ahmad investigation, e decide to withdraw and support anoda candidate from oda side of di continent.
For October, Pinnick tok of im support for Patrice Motsepe of South Africa: "If pesin dey wey sabi pass you, you need to learn from am and queue behind him and wait for your time."

Wia dis foto come from, AFP
Patrice Motsepe - South Africa
Africa 10th richest pesin wit money wey reach $2.4bn (according to Forbes), Motsepe no be stranger to football as im na di owner of top division Mamelodi Sundowns club for South Africa.
E announce say im go run early dis month and since then Nigeria, Sierra Leone and Botswana don show support for im candidacy.
Fun fact for una: Oga Motsepe big sister na di wife of South Africa president Cryril Ramaphosa.

Wia dis foto come from, Getty Images
Jacques Anouma - Côte d'Ivoire
Anouma wey bi former member of Fifa Executive Committee (now Fifa Council) between 2007 and 2015, announce im own desire some days before Motsepe own.
And now e don officially enter race after di Ivorian federation give am dia support.
Although dis na di second time im dey try run - after im first attempt 7 years ago.










