EPL Fixtures: 5 tins wey go change when Premier League resume for June 17

Wia dis foto come from, Getty Images
Millions of fans of Premier League football still dey happy ontop tori say one of di biggest leagues for di world go return on 17 June.
But dem sabi say some tins no go be like how e dey before?
So many tins don happun since 13 March wey dem suspend di Premier League because of coronavirus. One time, dem consider to cancel di season patapata.
Small time afta dem reason am say make dem end di season as e dey, make everybody carry go house di position wey dem dey for table - like di way France take do dia league. But di clubs way dis idea no favour for bottom of di table para.
But now clubs don sidon agree say make dem restart di season but wit conditions - some wey dem still dey torchlight.
Make we see tins wey we sabi go change come 17 June.
Player management
No be every player wey fans sabi fit return because clubs don agree say any player wey no feel say e safe to join team fit stay for house.
Also, players go continue to dey do regular testing when season resume - like dem don dey do. And if any player or staff test positive, e fit affect di team because all di pipo wey dey close to am need to isolate.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kick-off time
As di EPL resume nadis big clubs Manchester City vs Arsenal go start di action.
Before na only on Monday, Saturday and Sunday dem dey play matches but as e be now, match fit happun on any day of di week.
- Friday: 20:00
- Saturday: 12:30, 15:00, 17:30 and 20:00
- Sunday: 12:00, 14:00, 16:30 and 19:00
- Monday: 20:00
- Tuesday, Wednesday and Thursday: 18:00 and 20:00
Live on BBC
For di first time, BBC go carry live Premier League matches.
Dis dey come as organisers dey reason how to make sure say more pipo fit watch. Premier League oga Richard Masters say "E dey important to make say many pipo as possible fit watch matches for house."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Substitutions
Like how German league Bundesliga take do am when dem resume, Premier League fit consider to increase number of substitute players from 3 to 5.
End of Season
E don enta BBC Sport ear say na on Saturday, 25 July di 2019/2020 Premier League season go end.











