Anthony Joshua, Odion Ighalo, see list of richest sports stars wey dey 30 years and below

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester United and Nigerian striker Odion Ighalo dey among di richest players wey dey 30 years and below.
Ighalo wey join United on loan from China club Shanghai Shenhua dey 15th for di 2020 Sunday Times Rich List.
Di Nigerian wey go turn 31 for June na di only African player wey make di list as im dey valued at £18m.
Nigerian born British boxer Anthony Joshua dey number two position for di list and im be di only pesin wey no dey play football wey make di list.
Joshua worth £107m according to Sunday Times and e make majority of im money from di two fights against Andy Ruiz Jnr.
Top of di list of sports stars wey dey 30 years and below na Real Madrid player, Gareth Bale, wey dey valued at £114m.
Aside Ighalo, four other Manchester United players including: Paul Pogba, Davide de Gea, Anthony Martial and Luke Shaw make di 18-man list.







