Heat Under 30 Rich List: John Boyega, Michael Owuo aka Stormzy dey list of richest celeb wey dey 30 years and below

Wia dis foto come from, Axelle/Bauer-Griffin
Britishi-Nigeria actor John Boyega and Stormzy dey di full Heat Rich List for di 2019 top richest celebrities wey dey under 30.
Michael Ebenazer Kwadjo Omari Owuo Jr aka Stormzy, British rapper and singer worth £12m.

Wia dis foto come from, Getty Images
Stormzy wey be 26 years na new arrival to di list and im be number 14 for di list.
For 2019, di 26 year old achieved im first number-one single with "Vossi Bop" and im make headlines for im appearance for di 2019 Glastonbury Festival wen im wear Union Jack stab vest wey Banksy design.
Di musician win Best Grime Act for di 2014 and 2015 MOBO Awards.

Wia dis foto come from, Bill Watters/Getty
British born Nigeria actor 27 years old John Boyega, worth £6.6m pounds to make number 21 for di list.
John Adedayo Adegboyega, wey dem sabi for movie world as John Boyega, na British actor wit Nigeria mama and papa.
Boyega first blow for UK wen im act for 2011 sci-fi comedy "Attack the Block."
End of Di one wey oda users dey read well well
Im also act for different films of popular di popular Star Wars series.
Check out di complete list of di top 30 richest celebs dem wey dey 30 and below
1.Ed Sheeran, 28, (£170m)
2.Daniel Radcliffe, 30, (£90m)
3.Harry Styles, 25, (£64m)
4.Emma Watson, 29, (£57m)
5.Niall Horan, 26, (£54.8m)
6.Little Mix (£50m)
7.Louis Tomlinson, 27, (£46m)
8.Liam Payne, 26, (£44m)
9.Cara Delevingne, 27, (£39.5m)
10.Zayn Malik, 26, (£38m)
11.Sam Smith, 27, (£34m)
12.Aaron Taylor-Johnson, 29, (£21m)
13.Rita Ora, 28, (£17.8m)
14.Stormzy, 26, (£12m) - new entry
15.Dua Lipa, 24, (£11.8m) - new entry
16.The 1975, (£10.9m)
17.Sophie Turner, 23, (£8.5m)
18.Daisy Ridley, 27, (£8.4m)
19.Nicholas Hoult, 29, (8.3m)
20.Dev Patel, 29, (£7.5m)
21.John Boyega, 27, (£6.6m)
22.Sam Faiers, 28, (£6.3m)
23.Joey Essex, 29, (£6.3m)
24.Tommy Mallet, 27, (£5.2m) - new entry
25.Maisie Williams, 22, (£4.5m) - new entry
26.George Ezra, 26, (£4.4m) - new entry
27.Jess Glynne, 30, £4.4m - new entry
28.Olivia and Alex Bowen, 25 and 28, (£4.3m - joint) - new entry
29.Billie Faiers, 29, (£3.6m) - new entry
30.Tom Holland, 23, (£3.5m) - new entry










