Africa: See how stars abroad dey feel home dis season

John Boyega

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Star Wars actor John Boyega waka from Hollywood enter Lagos for di holiday and im say 'chill no dey'
Read am in 2 mins

Plenty people carry demself go house from oversea, on top say dem wan celebrate di holiday season.

But wetin you go do if you dey for entertainment and your hometown na for a different continent?

Dis international stars dey answer di matter with different ways.

John Boyega

Im na actor wey dey popular well-well, as di first black star trooper for di Star Wars movie series.

Boyega enter Lagos, Nigeria dis holiday say im wan come chill, abi relax...but soon im notice say chill no dey Lagos.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Big Shaq (Michael Dapaah)

Michael Dapaah na comedian wey become international superstar after im song "Mans Not Hot" go viral.

Dis holiday season, after nine years, im decide visit im Nana for Ghana and talk say na di highlight of im year.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Rotimi Akinosho

Rotimi as im dey call imself for stage na musician, but im dey popular for di role of Andre wey m dey play for di popular series, Power.

Although im no enter Nigeria dis season, na with social media e dey blast Nigerians on top say dem no send am Christmas present.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Anthony Joshua

Anthony Joshua na British boxer wey popular after im use technical knockout defeat Vladmir Klitcho for April.

But im dey always represent Nigeria and even though im no come house for Christmas, for social media im call imself di Pounded Yam Champ.