Anthony Joshua vs Andy Ruiz time: See Joshua 'brutal plan' for Ruiz Jr

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerian born British boxer Anthony Joshua go meet Andy Ruiz Jr inside Saudi Arabia on Saturday night for fight wey go decide im career for di World Heavy Weight Boxing Championship.
Di big fight wey evri dey wait for dem title am unification rematch, and e go takes place on Dec. 7 for Diriyah Arena - custom-built 15,000-seater venue inside Diriyah, Saudi Arabia.
Di fight go happun from 8:30 PM Nigerian Time on Saturday.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Joshua lost im world heavyweight titles to Ruiz jr wen dem first fight for New York on 1 June, 2019.
"I dey here to win, I no get fear for mind..., I don say my prayers and take time to embrace wetin go happun on for Saturday" Na wetin Joshua tok.
"I love dis belts, dia is no way me I go let dis belt dem go... I know say im lost weight... I ready for watever go come my way... Saudi Arabia na special place wia I go make history" Na wetin Ruiz Jr tok.
Di two boxers jam face to face on Wednesday evening ahead of di Saturday re-match to check dia weight.
Joshua vs Ruiz 2: See dia pulse dem
Joshua - Ruiz Jr
Nationality: British - American/Mexican
End of Di one wey oda users dey read well well
Age: 30 - 30
Height: 6ft 6 - 6ft 2
Stance: Orthodox - Orthodox
Reach: 82 in - 74 in
Record: 22-1-0 - 33-1-0
KOs: 21 - 22
Rounds: 91 - 151
Debut: 5/10/2013 - 28/03/2009
Nickname: AJ - Destroyer
How much Joshua and Ruiz go earn?
Tori be say Joshua dey set for one of di biggest ever paydays in boxing history.
You fit watch di match here:
Na Sky Sports and DAZN USA be di major tori pipo wey go show di fight.
Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post














