You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Transfer News: Which Premier League club buy beta market?
- Author, Emma Sanders
- Role, BBC Sport
Many pipo surprise wella for dis summer transfer window as clubs spend money, but which clubs get sense pass and which of dem buy beta market?
You remember Moneyball - di feem wey Brad Pitt recruit baseball players from Oakland A based on Informate wey im get?
Well, one London-based investment company Carteret Analytics feel say dem get one formula for footballers, wey dey dia system to take advise three Premier League clubs on new players dem fit sign.
According to dia finding from dis transfer market, Arsenal fit don pay too much money for Nicolas Pepe, Everton suppose get more from Idrissa Gueye and one newly promoted team get one of di best deals of di window.
How e dey work?
Carteret Analytics use dia system to advise seven clubs for England top two league dem and 12 big clubs from Europe and di rest of di world too.
Di data based on player value - dem go calculate fee based on dia performance for di club wey dey sell dem and di impact dem go get from di club wey dey buy dem plus dia age wey dey within (usually 26-30).
Also, di value as per money aspect wey di player dey contribute to win football match and di kain influence wey im get to create and stop goal-scoring opportunity dem.
By di time dem check dis value, clubs go make up dia mind to know how much dem want collect for di player head and how much too dem dey ready to spend ontop new player dem wey dem wan buy.
End of Di one wey oda users dey read well well
Arsenal do bad business?
Arsenal bin dey hot seat for transfer deadline day- dem sell Alex Iwobi to Everton and bring in Chelsea defender David Luiz and Celtic full- back Kieran Tierney. But how come dem dey for di bad business side.
Iwobi real value wen im bin dey Arsenal rise up to £46.26m but dem sell am for just £27.36m, wey suggest say dem undervalue am by almost £19m.
Arsenal sign Ivory Coast winger Nicolas Pepe from Lille for club record fee of £72m- £21.77m pass im real value figure.
And dem buy teenage defender William Saliba cheap from Saint-Etienne and let dia former captain Laurent Koscielny go to Bourdeaux for more dan £20m under im projected fee.
But Arsenal bring in replacement for Koscielny for good value. Dem rate Chelsea Luiz for £34.8m but Unai Emery team bring am in for £7.8m - no be bad deal for pesin wey don win Premier League and Champions League with plenty years of experience for England.
Aaron Wan-Bissaka transfer dey fair?
Even though Crystal Palace sell dia best young player, dem do beta business for di transfer window according to Carteret Analytics data.
And dem keep dia main player Wilfried Zaha, Palace buy Swansea striker Jordan Ayew for just £2.5m - wey less dan im intrinsic value.
Dey also collect beta money for defender Aaron Wan-Bissaka, although im value fit rise for future for Manchester United.
Dem sell Wan-Bissaka for £49.5m, im intrinsic value for Palace na just £23.32m. But dem expect di value to rise £43m for United but it still dey short of di money dem pay for am.
Everton buy well but sell poorly
Everton surprise pipo with di signing of 19-year-old forward Moise Kean from Italian champions Juventus. And di deal no bad, dem pay just £4m ontop im projected value.
Dem also sign Manchester City Fabian Delph for under £9m.Dem bin value di England international for £54.58m to im selling club.
Andre Gomes' permanent move from Barcelona cost just £22.5m too, a fee wey low pass im intrinsic value to Everton. And of course, di signing of Arsenal Iwobi na anoda good business.
But Everton no shine eye wen dem sell. Midfielder Idrissa Gueye move to Paris St-Germain fall short of im £26m intrinsic value.
Bournemouth and Wolves buy beta market
Di best business happun for clubs wey dey outside di Premier League top six.
Wolves smart for dia business for transfer market, dem sign loan players on permanent deals.
Benfica sign Mexico striker Raul Jimenez, wey score 15 goals for 37 games last season for club record of £34m- na good deal because im intrinsic value na £43.37m.
Dem also pay less for Belgian midfielder Leander Dendoncker wey value reach £16.13m afta im join dem on permanent deal from Anderlecht.
Oda clubs wey do beta business for transfer market na Bournemouth, dem buy Huddersfield midfielder Philip Billing for £15m - half of im projected value fee and dem sell defender Tyrone Mings to Aston Villa more than im rating.