Amaju Pinnick: Caf commot Nigeria football oga as dia vice-president

Pinnick

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Amaju Pinnick, head of the Nigeria Football Association
Read am in 1 mins

Di Confederation of African Football (Caf) don comot di oga of Nigeria Football Federation, Amaju Pinnick, from im role as dia vice-president, replace am with Danny Jordaan from South Africa.

Pinnick don dey serve as di first vice-president of Caf since July 2018.

Caf President Ahmad no give any reason while dem remove am but im sign agreement with Fifa President Gianni Infantino on Thursday to confam di appointment of Fifa Secretary General Fatma Samoura as 'General Delegate for Africa'.

Pinnick don reply.

"To serve as di number two football administrator for di entire African continent na excellent opportunity for me," Pinnick tok for statement.

"My commitment to di game still bam and my support for my colleagues for di Executive Committee still dey kampe."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Pinnick waka mean say Ahmad go need to reshuffle im vice-presidents, meaning say Constant Omari of DR Congo and Moroccan Faouzi Lekjaa go move up from second and third vice-president respectively.

Jordaan, wey play ogbonge role for di 2010 World Cup for South Africa - di only time dem ever play di tournament for di continent, go now act as third vice-president.

Lekjaa, meanwhile, dey face possible ban by Caf afta di Ethiopian football federation accuse di Morocco football federation president say im assault di referee following di African Champions League final between Wydad Casablanca and Tunisia Esperance.

Samoura, meanwhile, go start her role on August 1, wey dem go renew afta six months if both Caf and Fifa agree, in di hope to oversee ogbonge administration reform for Africa.

Caf don record plenti scandals recently.