You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Copa America 2019: Fans yab Lionel Messi as Argentina lose to Colombia
Some football fans dey yab Lionel Messi for Social Media afta Argentina lose dia opening match 2-0 to Colombia for Copa America for Fonte Nova on Saturday.
Colombia shock Argentina with goals from Roger Martinez for 71st minute and Duvan Zapata late inside di second half.
Fans enta Twitter dey yab Messi wey win di league with im club Barcelona dis season and finish as highest goal scorer with funny meme
Messi, wey be 31 years say "belle no sweet at all". as dem lose dia Group B match.
"We no bi wan start like dis, na wetin di five time Ballon d'Or winner tok.
"But now we need ginger ourself and continue to push."
Argentina don win di tournament 14 times followed by Uruguay but dem neva win an since 1993 and dem lose di last two finals on penarity to Chile.
Dia next match for di competition na against Paraguay on Thursday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di result mean say Colombia dey sidon ontop Group B with three points Ahead of Qatar wey go play Paraguay on Sunday.