You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Anthony Joshua lose im fight to Andy Ruiz
Andy Ruiz Jr shock many pipo for heavyweight boxing as im collect Anthony Joshua IBF, WBO and WBA world heavyweight titles from am.
Ruiz nack Joshua four times for ground before im finish am for di seventh-round to give di British-Nigerian im first defeat.
"Ogbonge fighter na im beat me," Joshua tok for Sky Sports. "Make we dey see how e go, but dis na all part of di journey.
"Im na champion for now, I go return."
Ruiz no even suppose to fight Joshua. Im take over di fight for six weeks notice afta Jarrell Miller wey suppose fight Joshua, fail drug test.
According to promoter Eddie Hearn, Joshua go get im chance to collect back im belts for rematch for London, around November or December.