AFCON Draw: Nigeria, Cameroon, Ghana don find out who go dey dia group

Africa Cup of Nations draw go happun today.

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

24 kontris wey qualify for di 2019 edition of di Africa Cup of Nations don find out who dem go play for di tournament.

Na Friday 12, April di di AFCON draw hold for Cairo, Egypt and di tournament proper go start for June, 2019.

Afta di draws, Nigeria find demsef for group B, while Cameroon and Ghana dey for group F.

Nigeria Super Eagles wey qualify for di tournament as winners of dia group go hope to win di trophy for di fourth time for dia history after dem win am for 1980, 1994 and 2013.

Ghana na anoda candidate wey dey also challenge for di top prize as dem bin don win di competition four times.

Meanwhile Cameroon don carry di cup five times and dem also qualify for dis edition with di hope of dem winning di trophy for di sixth time.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Who go fit meet each oda for di draw?

Pipo wey dey in charge of football for Africa, CAF on Thursday reveal di kontris wey go dey for di different pots ahead of di draw.

Dat one mean say, CAF rank di 24 qualified teams according to wia dem dey for di latest FIFA rankings into four different positions.

Dem go pick one team out of di four pots wey get six teams each to form one group.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Nigeria, Cameroon, Egypt, Senegal, Tunisia and Morocco na dem be di top ranked teams for Pot 1.

For Pot 2, Ghana, DR Congo, Mali, Cote D'Ivoire, Guinea, Algeria na dem dey inside.

Any of those teams for pot 1 and 2 fit meet South Africa, Uganda, Benin, Mauritania, Madagascar and Kenya wey dey pot 3.

While Zimbabwe, Namibia, Guinea Bissau, Angola, Tanzania and Burundi na dem form pot 4.